Tuesday, 11 February 2014

BBA Winner Dillish Breaks up with Boyfriend.

After several years of dating , BBA winner Dillish don knock her boyfriend 'Stephen', after the guy don support am before whe enter BBA house , come support am until she win , she con still come out the guy buy am car as gift , hmm na wa dem say money dey really dey bring out the kind person wen we be .
She don remove all them picture from her Instagram page and the guy too don do the same thing . hmmm na wa ooo

I Neva wan marry ooo -says Osita Iheme (Paw-Paw)

Last week them dey talk say Osita Iheme AKA Paw-Paw go soon marry Ghanaian Actress Nana Ama , well the actor don talk say him no get plans to marry yet , he still dey use lamp dey search for wife .
Him partner in carry do chinedu ikedieze Aka AKI don marry , he remain Paw-Paw wen go marry . Oya all the single ladies make una find am see after all the guy hold .
20140211-200542.jpgI want to help build the younger generation – Osita Iheme (Porpo)

Women fined N50k for wearing trouser .

According to people wen go there , Akwaihedi community for Nnewi South Local Govt area for Anambra don pass law say no more wearing of trouser , bum shorts or shakira for women , if dem catch you na N50k you go pay or dem banish you from them place .

Sources for there say na the youth help some female NYSC members if not them for naked them because them wear NYSC kaki trouser , Nigerian politicians with them yeye laws sef .

Sardie Disses all Ghananian Rappers


If we are to go by the lyrics on sarkodies latest song titled " Y'all ready know" where he claimed to be the best and declared that no other artist will shine in Ghana again unless he dies .
Shuooo see ooo sarkodie don dey mad , all this ranting start after fellow rapper attack am verbally in air one day .
For me i go say make sarkodie apologize oo cos wetin he talk so na Big tin .
Sarkodie-2

Lenovo Denies Deal With Iyanya! Busted .

sometime last week Iyaya enter instagram , annouce say he don get deal with another computer , tablet tech company Lenovo and him manage talk say the deal worth huge amount of money .
But the execs from Lenovo say dem no sign any deal with Iyanya ooo , say unless na another company bcos dem no know about any deal with Iyanya . But any way sha Iyanya still get other endorsement to take care of as this 1 blow .
Iyanya1 (1)

Oritse Femi Loses Dad

The PAPA of popular Singer oritse Femi AkA Musical Taliban No1 don die , we hear say the man no sick ooo , he just fall for ground na dem rush am go hospital , den later na he come die .
My condolence to Femi and may the soul of him Dad rest in peace .

Justine Bieber to be Deported .

American customs don dey prepare to deport canadian super star Justine Bieber .
The thing be say some time ago Justine and him friends use raw eggs scatter dem neighbor house yaga yaga , na dem call police for dem . so now the tin be say if dem find Justine and him friends guilty na be say he don violate him working visa condition , so dem go turn Justine to deportee .... all this na according to TMZ sha.

0210-justin-bieber-01

Black history (Zoo for africans)

Ok i know say most of una no know , but una know say dem be get human zoo for black pipol for europe and other white countries before before ??
these oyinbo sha , after dem catch black pipol for africa dem go put some for zoo like say dem be ordinary bush monkey , mchew .
Thank God say times don change sha and thank God for pipol like martin luther king and many other pipol .
see pics below .
this 1 dem dey give d pikin banana ..hmm Jesus

Sunday, 9 February 2014

Nigerian Woman disowns gay cat .

As the Nigerian Govt don post 7 years for associating with homosexuals , one nigerian woman for Nasarawa State don disown her cat "Bull" bcos d cat dey show Homosexual behavior , the cat dey chase only male cats and the woman get plenty female cats for am ooo.

The woman neighbors notice say no cat don born Bull pikin na be say Bull no get time for female cats only male , so now the woman don kick am out say anybody wen like am make he take am . more info
Nigeria cat homosexuality

Mandela Leaves $4million to family

Them don read the last will and testament of Late Nelson Mandella of south Africa . the iconic leader share him $4million property among him family , him ANC party and some schools for scholarships .
Good man na Good man . May his Gentle soul rest in peace .

Mario Baloteli Breaks Down in tears after Racist Taunts

23 years old Italian footballer Mario Balotelli wen dey play for AC Millan burst tears after fans start dey call am racist names after him game .
According to newsone Seria A fans dey always call the black italian yeye names any time he enter feild dey play for him club .
this kain tin no good at all .
Mario Balotelli

BUY RED ROSES FOR VALENTINE.

Valentine is around the corner and you can order real red roses for that special someone in your life ,Call Diris consults for your fresh roses from Holland . call them now on 07069366789,09091140208 Pin: 2B080793 for competitive prices and delivery .

http://www.wallgd.com/images/2012/12/desktop-backgrounds-computers-windows-vista-red-roses.jpg

Saturday, 8 February 2014

Kenyan Pastor charge members N2,800 to check their name in the book of life

This one don pass be careful oooo shuooo oghene biko , one pastor for kenya wen get helicopter of christ ministry dey ask him members to pay am Sh1,500 (N2,800)  so he go show dem if them name dey for book of life , the pastor say God don give am expo so he dey spy the book of life any time .
Na so people dey troop into the church dey pay the fee for the expo hmm Jesus get patience ooo he really talk say my people die or perish out of lack of knowledge .
Below na pic of the pastor and him helicopter church .

Friday, 7 February 2014

Will Smith and Jason Statham loses movie role

A-list actor will smith and Jason Statham no go act for the next installment of independence day and transporter respectively , as for Jason them no give reason why dem say he no go act for transporter4 but pipol dey talk say na bcos the actor dey very busy with Expendables 3 , fast and furious7 and Mechanic 2 .Transporter4 will be released later this year .
While Will Smith own be say the producers say him fees and personality too big for the film , as dem money no reach wetin the actor want .. long throat .the movie independence day 2 go enter cinema for 2016 .

http://www.aceshowbiz.com/images/news/will-smith-won-t-return-for-independence-day-sequel.jpghttp://www.aceshowbiz.com/images/still/transporter3_03.jpg

Ali Baba takes on Billionaire pastors

Ace comedian Ali-Baba took to twitter to talk about wetin some of our rich pastors no dey do to help the poor for dem church m as for me oo all these rich church n pastors with extremely poor members no good aba most of the miracle Jesus do came as help from him self why our pastors today dey find am hard to help their own members ? abi na Sin .
Ibeg make una see wetin bros Ali-Baba get to talk about the issue below

Song of the week .

See i know say dis music don dey tey small but i like am n na him b my song of the week , listen and enjoy for the weekend and remember no drink n drive ooo ibeg

Indian Man worshiped like a God after growing tail from his back!

1 Indian man wen tail dey grow from him back don dey get worshipers as many pipol believe say him na God , the pipol for him village believe say 35-year-old Chandre Oraon na reincarnation of the Hindu monkey deity Hanuman . incase you no believe see below for pictures .

Diddy proposes , puts a ring on it

After proposing to his long time girlfriend on instagram , rapper n business man Sean Diddy Combs don finally give the big diamond ring to him babe , him babe wen be RnB singer cassie show the ring for picture wen dem two take , patience they say is a virtue .Cassie-and-Diddy-engaged

Olu maintain signs with Def Jam

Mr Olu Maintain aka Mr yahoozee don sign world wide distribution deal with Def Jam recording and Def jam na American record label wen get artist like of Jay z , Kanye west under its belt , Olu maintain go be 3rd nigerian artiste after Dbanj n P square to sign juicy deal like this, upon this development the Mr Olu don say he go release the music video to him new song "too much efizy" pics below .

Fela did perform with just pants

To all my friends and fans wen dey follow me drag say Afro beat legend Fela Kuti no perform with pants , make una see some of the picture now , he did perform on stage with just pants so Burna Boy was not miss guided nor was he misrepresenting the Afro beat legend . Oya see pictures below .
Fela Performing on stage More Pictures of fela performing in his underwear
Image

Marley Re-Union

All the 14 children wen reggae legend born come together for some family time and enjoyment tins , all of them come together to celebrate the remembrance of dem papa wen suppose be 69 years old if he still dey alive . Just like he said 1 Love keeps us together . below na some picture of some of the marley children .
MarleyBrothers

Rick Ross buys Big Georgia House

Rick Ross aka BOSS don buy wetin people dey call the biggest house in the state of Georgia USA Rick Ross buy the house from former big name boxer evander holyfield , the house cost am $8 million and $1 million to maintain every year , the house is currently empty and e go cost the rapper some millions to furnish the house .
Below are some pics of the house .
imageimage

New Video : Davido- Aye

Make we enjoy dis one for the weekend sweet music , sweet like tomtom

New Video: Dj xclusive feat Olamide : Ibebe


Thursday, 6 February 2014

Chidinma Buys New Range Rover .

Capital hill Record artist, former project fame west africa contestant and MTN ambassador Chidinma don buy herself new range rover #enoeasy the singer go online go talk say she don buy am and she happy well well for her new car her own words below .
I love this new ride… #biggerandbetter #hardworkpays #mysweat #notagift #hello2014 #glorytoGodnotman #moreworktobedone #Godisfaithful
 the singer dey work on her upcoming slbum wen shen don plan to release sometime this year 


 

Jay Z and Beyonce to buy a new house


Hip-Hop boss Jay-Z and him wife Beyonce Aka mama blu don buy 1 new big house for outside New-york the house cost them like $15 million , the house get 6 rooms , office , studio , balling alley and better playground for baby Blu .
Below are some picture of the new house , Big man tins .







Taliban capture American Dog

The Taliban's wen dey Pakistan dey hold american Dog hostage , LOL.
The talibans for pakistan dey talk say dem capture one american military dog last year december and them still dey hold the dog hostage dey wait negotiation from America .
These people no get work wetin una go lem with yam pepper soup una wan show una self .
below na d picture of the dog wen dem hold .
Taliban capture military dog 2014 02 06

2 chain produces first shoe

Hip-Hop rapper 2 chains don join force with big name sport wear manufacturer Adidas produce him first sneaker , 2 chaine dey call am "2 good to be T.R.U" the show na combination of black suede and black leather snake skin design with gold anchor .
Currently you can buy this Shoe from store for $130 .
better leg.


adidas top ten 2 chainz 2 good to be tru 8 2 Chainz x adidas Top Ten Hi 2 Good to be T.R.U.

China's Rich and powerful run to america

As china don start to dey burst all the rich and corrupt people for their country , all the rich pipol wen hand neva touch don dey run go stay different countries as citizens , countries like america , holland , australia , na dem dey run go .
According to globalpost.com 399 chinese wen get at least $1.6 million or more don get citizenship for USA with 2 years all bcos of say dem govt dey light fire for dem corrupt yansh and dem cup don full .
I pray say Nigeria go follow this step oooChina billionaires luxury goods

DMX to fight Zimmerman

DMX don agree to fight Zimmerman for one celebrity boxing match .
DMX wen be known jonky , wen dey smoke coco , whitey and plenty plenty banned drugs , don say he go fight George Zimmerman wen kill that black innocent boy just bcos say d boy dey waka for him back for night , the two men sha no be professional boxer sha  . Omo dis one no go easy ooo DMX na rap n shout na we sabi u for ooo , but him celebrity friends don dey beg am make he no fight sha and DMX lawyer don talk say dem don agree but dem neva sign contract yet bcos dem neva see am , May that contract lost ooo Amen .

Paul Walker will his wealth to his 15 y/o pikin

According to TMZ that big name actor wen act fast and furious when die for car crash Paul Walker , give all him $25 million plus to him only pikin Meadow Walker .
The actor draft the Will for 2001 and he say na him mama go look after the girl when he die , Meadow na just 15 years old . we sympathize with her sha , we pray the cash eases some pain wen the death of her dad caused .
The girl don hammer 0204_paul_walker_meadow_walker_tmz_getty

YUNG 6IX Release Debut album

Prolific South South rapper Yung 6ix , has released is debut album . after breaking into the music scene with his remake of the smash hit oleku by ice-prince and after he release some singles and free style after free style , we him core fans come dey wonder weda na free style na we go chop ? But thank God say after he don cook cook cook for years the album don set (haters chop fowl n die) d album feature big names like MI , ice prince , Phyno, Olamide, Da Les n more . you go fit buy the album on itune for now hard copy will be released soon . click here here for list of songs .

http://notjustok.com/wp-content/uploads/2014/02/Yung6ix-Album-Art.jpg

Tuesday, 4 February 2014

P.Diddy Jointly Buys Deleon Tequila

celebrity rapper turned business mogul Sean "Diddy" Combs and Larry Schwartz have bought luxury U.S. tequila brand DeLeon, hoping to repeat the success he (Diddy) have had with the company's fast-growing Ciroc vodka.

The American record producer, actor and entrepreneur became the face of Ciroc in 2007 under a joint marketing and profit-sharing deal which has brought a near 40-fold rise in annual sales volumes for the brand's products.

"With Ciroc, we dated. Now with DeLeon, we're married," Combs said in an interview. "This deal is way better. This makes me a true owner."

Congratulations to P Diddy on to the next 1